Get It Together lyrics

Songs   2024-07-07 09:31:25

Get It Together lyrics

Paul

(Listen, eeeh)

Proper planning na him dey save

No go do mistake

Them go tell you say, eaya brother

Your days will be shining your future great

Brother no story oh

Make you no regret, eaya

If na to celebrate, you go plan am well

If na your planning day, naso you go run away

So come make you gum body with your baby boo

Seat down and discuss am well like you suppose to do

Cause the people wey sabi na dem wey dey plan well oh

(Na dem wey dey plan well oh)

The people wey sabi na dem wey dey plan well oh

(Na dem wey dey plan well oh)

For you wey no sabi oya come make we yarn well oh

(Oya come make we yarn well)

Like this, like that

Like this, like that

Oya get it together

Plan well oh, oh oh oh

(Tiwa Sa-vage)

Tiwa Savage

This thing wey you dey talk oh, e dey sweet my body

Dey totori my belle oh, oh oh oh eh

Na woman wey sabi, na hin go plan well oh

And she go find the one wey go gel for her body

If na our wedding day, we go plan am well

If na our planning day, na so we go run away

So make we join body, my baby boo

Make we discus am well oh like we suppose to do

Cause the people wey sabi na dem wey dey plan well oh

(Na dem wey dey plan well oh)

The people wey sabi na dem wey dey plan well oh

(Na dem wey dey plan well oh)

For you wey no sabi oya come make we yarn well oh

(Oya come make we yarn well)

Like this, like that

Like this, like that

Oya get it together

Plan well oh, oh oh oh

Paul

Who no know go know

Who no know go know

Wetin be the lesson

Planning na the blessing

E go help you dey manage money

Dey manage money

E go help you to manage your time and attention, eeeh

Tiwa & Paul

Get it together you need to know

We need to talk am oh

Get it together make we dey go

Eh lelele

If na to make money, we go plan am well

If na our planning day, na so we go run away

So make we join body, my baby boo

Make we discus am well oh, like we suppose to do

Cause the people wey sabi na dem wey dey plan well oh

(Na dem wey dey plan well oh)

The people wey sabi na dem wey dey plan well oh

(Na dem wey dey plan well oh)

For you wey no sabi oya come make we yarn well oh

(Oya come make we yarn well)

Like this, like that

Like this, like that

Oya get it together

Plan well oh, oh oh oh

Tiwa Savage more
  • country:Nigeria
  • Languages:English, English (Nigerian Pidgin), Yoruba, English (Middle English), Swahili
  • Genre:Folk
  • Official site:
  • Wiki:https://en.wikipedia.org/wiki/Tiwa_Savage
Tiwa Savage Lyrics more
Tiwa Savage Featuring Lyrics more
Excellent Songs recommendation
Popular Songs
Artists
Songs